UK temporary work visa: 82 jobs dey shortlisted by authorities for first stage
Wia dis foto come from, jackyenjoyphotographyPublished 10 October 2025Read am in 4 minsDi United Kingdom migration advisory committee (MAC) don publish new report of 82 mid-skilled jobs wey fit qualify foreigners for temporary visa under di migration pathway, dis move go address di kontri labour shortages. Di Home Office, report identify key roles essential wey go strengthen di UK economy, as part of di govment efforts to manage pipo wey wan migrate into di kontri while sustaining economic growth.Inside di report, di 82 jobs from di MAC dey part of di Britain Temporary Shortage List and dis na di first stage review.B1 level na di required level of English language proficiency for foreigners.Dis na new way to allow foreigners work for short period for UK, and e no fit lead to permanent residence becos di visa go only last for 3-5 years.UK goment believe say di Temporary Shortage List na ways to target immigrants wey get di skills and address...
![UK opens doors to foreign workers as 82 jobs are up for grabs [Full List]](https://www.nairalanceblog.com/wp-content/uploads/2026/08/UK-FOREIGN-WORKERS.webp.webp)






